BlankPaperz Short Piece Contest longlist
The person I go like be tie many gele—remember Boy Alinko for Papa Ajasco and im many specs? Na so I wan make my eyes see the world and make people for world take see me. Multidimensional but all the colours align for one person head; one centre. The person wey I go like be na woman wey hold ground for many places. Professor, advocate for people with disabilities and education for children in educationally-disadvantaged communities, woman wey dey criticize African and Nigerian literature make people for obodoyibo take know the true story for wetin happen for we country as we take write am.
The person wey I go like be don dey knock for my head since. The professor na since grandmama call me ogomodiri, “human being wey dem born to read book” (my head kuku dey inside there every time). Everything: my dreams, my empathy, everything connect go there. You don ever run school field round hear as your heart dey beat? Na so my own dey pound when I do anything relating to books. If I read, teach, donate, write, my heart dey beat as e suppose. Many fashions of one thing ontop one woman head.
Ude, Ugo Anna is a student of English at the University of Lagos. As one deeply interested in African literature, Ugo studies and writes essays about African culture and literature. She critiques literature sharing her reviews on her bookstagram @gushing_torrents. Ugo’s essays and contributions appear in Literandra, Kurating Mag, Poemify, LOATAD and on Feast Afrique. She also runs The Book Drive Bayelsa to donate books to children in educationally-disadvantaged communities. Follow her on Facebook: Ude, Ugo Anna.