I No Love Again by Nature Photographer | Monday Ogar

Dem say love go make me whole Cure me of my soji, make me bold Forget my poverty, make me feel I hold Feel like celebrity, 2chains with all im gold Claim Eko boy for Calabar, as Cross River don broke But I swear no be so e bin go. As I love her… My …

No love again

Dem say love go make me whole
Cure me of my soji, make me bold
Forget my poverty, make me feel I hold
Feel like celebrity, 2chains with all im gold
Claim Eko boy for Calabar, as Cross River don broke
But I swear no be so e bin go.

As I love her…
My sweet mama she make me forget
My job, my appointment letter she make me I tear
My state of origin, I tell you naim I first forget
My guys, she make I disconnect
And all my money she collect
As my account na she dey receive alert.

Now when you call love
I dey dodge like militant wey sight JTF
Because when I think am I dey shed tears
As when I reason the journey, my liver the fail
Because this thing call love e no jell.

By Ogar Monday

About Monday

Ogar Monday is a journalist with crossriverwatch, a street photographer, an art lover with an addiction to shapes, size and colours. follow him on IG: @calabarlens

BlankPaperz

BlankPaperz

Amplifying voices and stories.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Related stories

Watch Isaac Daniel’s PROUDLY AFRICAN

To All Women and Sisters Fighting Silent Wars: Superwoman

Body of Mine

Ofem Ubi’s Photography Meets Poetry #6

Ofem Ubi’s Photography Meets Poetry #5